You are here: HomeAfrica2021 07 06Article 1303165

Africa News of Tuesday, 6 July 2021

    

Source: www.bbc.com

Ghana opposition NDC stage 'March For Justice' demonstration for Accra

Plenti pipo carry placards dey demand justice for deaths Plenti pipo carry placards dey demand justice for deaths

Ghana opposition party, National Democratic Congress (NDC) go embark on March for Justice demonstration today.

De demonstrators dey protest de growing levels of injustice in de country from police den military officials.

De NDC Youth wing led demo start from Accra Mall den end for around Parliament House areas.

Ghana Police Service initially indicate say dem no go allow make de protest happen sake of Covid-19 restrictions, but dem later make u-turn on de decision to allow de protest.

But de police say de choice of route by de NDC be problematic, sake of dat dem go monitor de movement.

National Youth Organizer of de NDC, George Opare Addo talk say dem go submit petition to President Akufo-Addo.

The Police have agreed to provide security during the protest after earlier declining citing covid-19 imposition of restriction.

De NDC youth wing get support from pressure group Inter-Party Resistance

Against the New Voters Register (IPRAN), made up of group six other political parties.

Dem also invite #FixTheCountry campaigners make dem join de demo.

Read full article