You are here: HomeAfrica2021 09 05Article 1349764

Africa News of Sunday, 5 September 2021

    

Source: www.bbc.com

Guinea 'coup': President Alpha Conde reportedly dey under arrest by security forces

Guinea President, Alpha Conde play videoGuinea President, Alpha Conde

Reports say security forces don arrest 83 years old Guinea President Alpha Conde, inside wetin appear to be coup attempt.

Dis na according to tori pipo Guineenews wey private pipo dey run.

"From credible sources, Guineenews don learn say special forces wey Commander Mamady Doumbouya wey dey head di elite unit don arrest Guinean president.

"According to di same sources, many other dignitaries of di regime dey in di hands of di special forces," di news website tok.

Earlier today, local sources bin report say Conde "dey do well and dey under di protection of im presidential guard" after gunshots sound near di presidential palace.

RTG TV wey be state-owned, don continue to dey run programmes as normal with no any sign of instability for di capital, Conakry.

President Conde re-election for a third term for October 2020 hapun with controversy. Im campaign bin provoke ogbonge protests and security forces bin crackdown on di opposition.

Read full article