You are here: HomeAfrica2021 10 01Article 1370461

Africa News of Friday, 1 October 2021

    

Source: www.bbc.com

South African president announce new COVID-19 vaccine certificate

South African President, Cyril Ramaphosa South African President, Cyril Ramaphosa

South Africa President Cyril Ramaphosa don announce one new COVID-19 vaccine certificate, wey e say go ease travel and access to events wey need proof of vaccination.

For one speech for TV, e say e bin press Britain to relax travel restrictions wey dem impose on im kontri after im discuss di matter wit Prime Minister Boris Johnson.

"Streamlining and standardising proof of vaccine go also go long way to get some number of international travel restrictions both from and into our kontri eased," na so di president tok, but e no tok di time of di roll out.

"We bin agree say di decision of dis nature suppose dey inform by science, and we dey hopeful of one positive outcome when di issue come up for review in di coming days by dia scientists."

Di kontri ease Covid-19 restrictions

Oga Ramaphosa also remove covid restrictions.

E reduce di number of hours of nationwide curfew now in place from midnight to 4am.

E end ban on weekend sales of alcohol and allow larger public gathering.

Oga Ramaphosa add say di goment dey reason to administer 250,000 first dose vaccine every single weekday until mid-December.

Read full article