You are here: HomeAfricaBBC2021 09 18Article 1360486

BBC Pidgin of Saturday, 18 September 2021

    

Source: BBC

2021 Most Beautiful Girl in Nigeria event dey hapun for Lagos - See wetin you need to know

Oluchi Madubuike, Miss FCT don win di Most Beautiful Girl in Nigeria, MBGN 2021 pageant Oluchi Madubuike, Miss FCT don win di Most Beautiful Girl in Nigeria, MBGN 2021 pageant

Di 33rd year of di Most Beautiful Girl in Nigeria, MBGN dey happun on Saturday di 18th of September for Eko Hotel, Victoria Island, Lagos.

Di winner of di 2021 MBGN go represent Nigeria for Miss World pageant wey dem go do for Puerto Rico for 16th of December 2021.

Dis year edition, na comedian Bovi and media personality Toke Makinwa be hosts.

For 2019, Nyekachi Esther Douglas win di MBGN crown, she go on to win di Miss World Africa for di Miss World Pageant for 2019.

She bin win di heart of many Nigerians with her reaction to who win Miss World 2019, Miss Jamaica.

MBGN bin no hold for 2020 sake of coronavirus.

Di 2021 edition of di pageant dey hapun 20 years afta MBGN Agbani Darego win di Miss World crown for 2001.

Dem no do MBGN for 2020 because of COVID-19.

Dis year dey boast of thirty seven ladies wey dey vie for di crown and di selection happun online.

Read full article