BBC Pidgin of Tuesday, 15 November 2022
Source: BBC
Na Five days remain for di 2022 Fifa World Cup wey dey happun for Qatar to start.
Football fans around di world don dey catch di World Cup fever. As belle dey sweet di kontris wey qualify, pepper body dey worry some big kontris wey miss out.
Nigeria, Cote D'ivoire, Algeria and Egypt no qualify for Africa, Italy, 2018 hosts Russia and Norway wey get di hottest striker for Premier league now Erling Haaland no go for Europe.
Africa na one of di controversial continents wey football fans get mixed feelings about, sake of say dem get plenty stars, ogbonge players wey dey make name for dia clubs, but yet dem neva win di World Cup before.
Even though fans dey enjoy African teams wen dem play for di biggest international football fiesta for di world, di same football fans no dey expect too much from dem.
Africa fit make progress pass di semi-final stage with di squads wey dey represent di continent?
Dis na question pipo dey ask Ghana, Tunisia, Cameroon , Senegal and Morocco.s.
Meanwhile, make we torchlight dia final squads.
African team squads for Qatar World Cup 2022
Ghana
As Nigeria no qualify for di World Cup West Africa fit don ready to give arch rivals Ghana all di support. Afta Ghana qualify for dia first World Cup for 2006, dem become di third African nation to qualify for di quarter finals for di 2010 edition for South Africa.
Ghana dey Group H wit Portugal, Uruguay, and South Korea
Ghana Squad
Goalkeepers: Lawrence Ati Zigi, Nurudeen Manaf, Ibrahim Danlad.
Defenders: Tariq Lamptey, Alidu Seidu, Alexander Djiku, Gideon Mensah, Dennis Odoi, Daniel Amartey, Mohammed Salisu, Joseph Aidoo, Baba Abdul Rahman.
Midfielders: Andre Ayew, Mohammed Kudus, Thomas Partey, Elisha Owusu, Daniel Kofi Kyereh, Abdul Salis Samed.
Forwards: Osman Bukari, Williams Inaki, Jordan Ayew, Daniel Afriyie Barnieh, Sowah Kamal, Antoine Semenyo, Kamaldeen Sulemana, Abdul Fatawu Issahaku.
Head Coach of the @GhanaBlackstars Otto Addo has named his squad for the FIFA World Cup.
— Ghana Football Association (@ghanafaofficial) November 14, 2022
???? https://t.co/1mwuWcPFho#BringBackTheLove | #BlackStars pic.twitter.com/OBMGclDIim
Read full articleListe des 26 #LionsIndomptables qui iront défendre les couleurs du Cameroun à la Coupe du Monde FIFA Qatar 2022.
— Les Lions Indomptables Officiel (@LIndomptables) November 9, 2022
PRÉPARATIFS DE LA COUPE DU MONDE FIFA QATAR 2022#CMRJAM | #FRIENDLY | #FIFAWC2022 | #QATAR2022 | #ALLEZLESLIONS | #LETSROARTOGETHER | #INDOMPTABLES pic.twitter.com/lwa6mWrUOZ