You are here: HomeAfricaBBC2021 08 23Article 1339522

BBC Pidgin of Monday, 23 August 2021

    

Source: BBC

Abesim murder: Suspected serial killer wit human flesh for fridge bore Ghanaians

Di suspect dey hand of police as investigation dey continu Di suspect dey hand of police as investigation dey continu

One 28-year-old man dey tell Ghana police what he know about de suspected murders for de Bono Region.

Ghana Police dey investigate de murder of three people wey appear like serial killings.

Di suspect wey be architect, chop arrest on Friday for Alaska near Abesim for Bono Region.

Ghana Police Service say de arrested suspect don allegedly murder 12 and 15years pikins plus anoda pesin wey dem dey try identify.

Ghanaians dey bore as dis dey remind many of de missing Takoradi girls palava wey ben occur recent.

De police tok for statement say dem effect de arrest after dem search en quarters".

"De police with collaboration from de community pipo don arrest one suspect wey dem give en name as Richard Appiah wey currently dey police grips dey assist with investigation".

Dis be according to de statement signed by Assistant Commissioner for Police Kwesi Ofori.

De Acting Inspector General of Police Dr. George Akuffo Dampare don give directives to fast track de investigation, de senior police official tok.

Dampare order CID officers for de police headquarters for Accra say make dem give technical support to de Bono regional police CID for Sunyani take reveal de person wey kill de three pipo for Abesim.

Di statement further tok say "di police, togeda wit di community pipo don arrest one suspect Richard Appiah wey currently dey police net dey assist wit investigation".

Acting inspector general of police George Akuffo Dampare direct CID officers from dI police headquarters to give technical support to di Bono regional police CID so dem go fit fast track di investigation.

Ghana police arrest witch doctor wey direct two teenagers to kill virgin for ritual money

Tori wey enta BBC Pidgin domot be say di suspect bin deceive di 13-year old boy from di football field to im room before e kill am.

Na wen di father of di boy dey search for im pikin, alarm come raise and dem report di matter to di Sunyani police on friday night.

E tell police say oga Appiah bin come for im 12-year-old son at about 5:30 pm but dem no fit trace di young boy after den.

About one hour and half later, some relatives of di suspect bin go back to di police station wit Appiah say dem suspect say e know were di 12-year-old boy dey.

Police wit di community pipo bin gather enter di suspect room before dem discover di boy body flat for ground plus oda human body parts for inside fridge and oda parts of di house.

Police still dey investigate di matter.

Dis no be di first time dis kind tin go happen for Ghana, for April, Police bin arrest one witch doctor wey bin direct two teenagers to kill virgin for ritual money.

Read full article