You are here: HomeAfricaBBC2022 01 09Article 1440574

BBC Pidgin of Sunday, 9 January 2022

    

Source: BBC

Afcon 2021 fixtures: Afcon tables plus changes wey Caf make ahead of tournament

Di AFCON cup Di AFCON cup

Football join bodi for Africa CAF don release new rules wey teams go observe through out di African Cup of Nations tournament wey go kick off on Sunday, January 9 for Cameroon.

For statement CAF say dem go allow five substitutions during each match for each team. To avoid disruption during matches, CAF say dem go only allow three chances for di teams to do dia five substitutions.

Dis mean say teams fit change two pipo at a time but dem no fit stop di match five times for one team to make changes.

Afcon Table and fixtures

Wetin di changes to number of substitutes mean

Caf go allow teams to do substitutions during half time. If di two teams do changing same time, e go count as one of dia substitution opportunities.

Dem go allow unused substitutions to be carried over to di extra time. If di game enter extra time, CAF go allow make dem do one more substitution.

Teams go fit do changes before start of extra time and during half time break of di extra time.

Wetin go happun if Covid-19 affect teams?

Caf say if any player test positive to Covid-19 before any game, dem no go allow am to play di match and dem no go allow am near di stadium.

Di African football body add say if upto eleven players test negative to Covid-19 for one team before start of di match, di team go proceed wit di match.

If di goalkeeper(s) test positive to Covid-19, di team go substitute am wit player wey test negative.

Any team wey no get upto eleven players wey test negative to Covid-19 before a match, dem go rule say di team don loose dat match by 0-2.

For exceptional cases, di Afcon organizing committee go take appropriate decisions.

Host nation Cameroon go kick of di tournament today (Sunday) wit a match against Burkina Faso.

Afcon new prize money

Caf Executive Committee don agree to increase di prize money of di TotalEnergies Africa Cup of Nations Cameroon 2021.

Dem take di decision afta one Executive Committee meeting wey President, Dr Patrice Motsepe lead for Douala, Cameroon.

Di new TotalEnergies Africa Cup of Nations Prize Moni na:

- Winner: USD 5 million (increase of USD 500 000)
- Runner-up: USD 2.75 million (increase of USD 250 000)
- Semi-Finalists: USD 2.2 million (increase of USD 200 000)
- Quarter-Finalists: USD 1.175 million (increase of USD 175 000)

Dis one represent a total increase of USD 1.850m for di TotalEnergies Africa Cup of Nations prize money.

Video Assistant referee

Di 2021 edition of Afcon go witness di use of Video assistant referees (VAR) for all 52 matches for di first time.

Caf use di technology from di quarter-finals for di 2019 edition of di tournament wey Egypt host.

Di African football bodi don select 24 referees, 31 assistant referees and eight video assistant referees from 36 kontris for di tournament in Cameroon, Rwandan referee Salima Mukansanga dey among four female officials.

Two officials from North and Central American and Caribbean football confederation Concacaf, Guatemalan referee Mario Escobar and Mexican VAR official Fernando Guerrero go also dey included as part of inter-confederation skills exchange program.

Read full article