BBC Pidgin of Monday, 27 December 2021
Source: BBC
Armed men don carry Uche Nwosu di son in-law of former Imo state Govnor Rochas Okorocha.
Tok-tok pesin for Okorocha, Ebere Nzewuji say dem carry Nwosu during church service for Saint Peter Anglican church Nkwerre for Imo state.
Police neva tok anything about di incident.
How di incident happen
One video wey dey circulate for social media show how di armed men invade di St. Peters Anglican church.
Dem shoot sporadically for air to scare pipo comot.
But di reaction of di pipo show how everybody run go hide.
Di voice behind di video claim say di armed men vehicle carry goment plate number - BBC neva fit verify dis tori.
"Dem put Uche Nwosu for booth," na so di voice tok.