You are here: HomeAfricaBBC2021 09 27Article 1366993

BBC Pidgin of Monday, 27 September 2021

    

Source: BBC

Babtunde Fashola: 'I no get hand for 2023 presidential campaign poster'

Nigeria minister Fashola say he no get hand for presidential campaign poster wey pop up Nigeria minister Fashola say he no get hand for presidential campaign poster wey pop up

Nigeria Minister of Works and Housing, Babatubde Fashola say im no get hand for one presidential campaign poster wey bin go viral for social media for weekend.

Di poster bin show di Minister and Govnor of Borno state, Prof. Babagana Zulum pose as presidential and vice presidential candidates wey one support group, "Di Nigeria Project 2023" dey behind.

However oga Fashola media aide, Hakeem Bello for inside statement say make Nigerians ignore di poster as di group no contact di minister or ask for im consent before dem issue invitation.

Di Nigeria Project 2023 wey dey signed by one Abayomi Mademaku as di convener, say di group go launch di campaign on October 2nd.

No be only oga Fashola wey be former Lagos state govnor don come out to say im neva show any interest to run for 2023 general elections.

Earlier, tori say Nigeria Vice President, Professor Yemi Osinbajo go run for President for 2023 bin also fly up and down as pipo don already dey drum campaign for am but e comot to deny di tori.

Also di presidential candidate for di Peoples Democratic Party during di 2015 general election, Atiku Abubakar and di Ekiti state governor, Kayode Fayemi bin say dem no get hand for online posters wey bin declare support for dem as president for 2023.

Meanwhile, Southern govnors for inside communiqué afta one recent meeting dem get bin agree say di next president of Nigeria must comot from di southern region.

Read full article