You are here: HomeAfricaBBC2022 01 19Article 1448188

BBC Pidgin of Wednesday, 19 January 2022

    

Source: BBC

Boris Johnson: Nobody warn me say drinks event dey against rules - UK Prime Minister

Boris Johnson, di UK Prime Minister Boris Johnson, di UK Prime Minister

Boris Johnson don "directly" deny say dem warn am say drinks party for di No 10 garden risk breaking lockdown rules.

"Nobody warn me say e dey against di rules," di prime minister tok, e add say: "I for remember dat."

Im former aide Dominic Cummings say e bin warn Oga Johnson dat time, and don accuse am say e mislead lawmakers about am.

Dem bin ask Boris weda e go resign if dem find say e bin mislead MPs, Oga Johnson say: "make we see wetin di report tok."

Senior civil servant Sue Gray dey due to publish one report into allege Covid rule breaking for lockdown get-togethers for Downing Street and government departments.

Oga Johnson bin also make one public apology to di Queen sake of No 10 parties on di eve of di Duke of Edinburgh funeral for April last year.

Im bin show e dey feel bad wen dem dey question am about di party, e bin say: "I deeply and bitterly regret say e happen.

"I fit only renew my apologies to Her Majesty and to di country sake of di wrong judgements wey dey made, and for dat I take full responsibility."

On Friday, Downing street bin tok sorry to Buckingham palace sake of di two staff party wey Oga Johnson no attend on 16 April, 2021.

Di next day, di Queen bin siddon alone do social distance from her family as she dey mourn her husband.

'End of di road'

For im blog, Dominic Cummings, wey bin still dey work for Downing Street dat time of di drinks party on 20 May 2020, bin claim say di Prime Minister no listen to im warnings.

Oga Cummings say di idea say senior aide, di PM Principal Private Secretary Martin Reynolds for no check wit Oga Johnson, after e bin kollect warning for im invitation to drinks for di Number 10 garden break di rules, "no dey credible".

Two oda former Downing Street official tell BBC say dem remember say Oga Cummings bin tell dem dat day say e advise di prime minister say make e no allow di drinks to go ahead.

When dem ask am about wetin Oga Cummings' bin claim wen e bin visit one North London hospital, Boris Johnson say: "I fit tell you direct say nobody say dis be something wey dey against di rules, wey dey against di Covid rules."

To respond to im latest statement, Labour deputy leader Angela Rayner say: "Boris Johnson clearly know say na di end of di road.

"E be di prime minister, na im set di rules, e no need anybody to tell am say di party e bin go break dem.

"If e bin get any respect for di British public, e go do di decent thing and resign."

Lib Dem leader Sir Ed Davey say di prime minister "just dey make di case worse for imself" wit im "empty excuse" and "transparent lie lie".

Di SNP deputy Westminster leader Kirsten Oswald say e dey "clear say di prime minister no dey frank" about di events for Downing Street garden.

You fit call di "nobody tell me" defence?

But mixture of beg beg say e no know and show say e feel bad and dey enough for di prime minister?

BBC Political Correspondent, Damian Grammaticas say, imm be, of course, di person in charge, wey decide how all of us go limit our behaviour during di pandemic, so di line of defence open am up to new attacks.

Weda im understand di rules? Se im need somebody to point out breach?

Even if e think say dis na work event e dey enough? - bicos work events also no dey allowed in May 2020.

Sue Gray inquiry fit find say no clear evidence say e, tell say di drinks event for im garden be breach of rules.

But wetin voters go tink?

E go shape wetin Tory MPs tink of dia leader.

Na delicate position for prime minister wit poll rating wey already dey go down.

Inside im interview, Oga Johnson repeat di apology e bin make to MPs last week sake of "mistakes" wey im make bicos of di May 2020 get-together.

"As I tok for di House of Commons, wen I bin go out to dat garden I think say I dey attend work event."

E say e bin no see di email wey Oga Reynolds send to invite staff to "socially distance drinks for di No 10 garden".

"I only see am di oda day. I only see am when e dey out ," di PM tok.

"Wetin I remember be say I go out to di garden for one short time and for 25 minutes to thank staff wey work on Covid, wey dey continue to work on Covid, and den go back to di office.

"If I get my time again, I no go allow tins to develop dat way."

Dem ask am weda im bin lie to Parliament over di party, e say: "No. I want to begin by repeating my apologies to everybody for di wrong judgements wey I don make, wey we fit don make for No 10 and beyond, whether for Downing Street or throughout di pandemic."

Oga Johnson say e go make further statement for allege rule-breaking for Downing Street wen Sue Gray publish her report, wey dey expected shortly.

Six Conservative MPs don publicly declare no confidence in di prime minister so far, as Labour, di Liberal Democrats and SNP dey urge am to resign.

Fifty-four Tory MPs must write letters to call for Oga Johnson to go in order to trigger one party leadership contest.

Cabinet minister don rally round di prime minister, wit Chancellor Rishi Sunak saying "of course" e believe Oga Johnson version of events.

Deputy Prime Minister and Justice Secretary Dominic Raab say prime ministers go normally dey expected to resign if dem bin find to don mislead MPs, but e believe Oga Johnson go remain in power for "many years".

Read full article