You are here: HomeAfricaBBC2021 06 10Article 1283017

BBC Pidgin of Thursday, 10 June 2021

    

Source: BBC

Buhari in Lagos: Wetin Nigeria Presido dey go do for di commercial city

Buhari as he dey leave Abuja on some foreign trip Buhari as he dey leave Abuja on some foreign trip

President Muhammadu Buhari dey expected to visit Lagos, Nigeria commercial city on Thursday, 10, June, 2021.

According to reports e dey come for di launching of di 157 kilometre Lagos-Ibadan standard rail project for di Mobolaji Johnson railway station for Ebutte Metta.

Presidential aide to di president Bashir Ahmad wey confam di news on Wednesday say: "Construction start March 2017, and test-running begin for December 2020,"

"Di Ebute Metta Station, wey pipo sabi as Mobolaji Johnson Station, na di largest railway station for West Africa with a holding capacity of 6000 passengers.

"President Buhari dey committed to developing a modern national railway network wey go connect every part of Nigeria, and promote trade, travel, tourism, commerce and national integration." E tok.

Afta dia, di president dey expected to move to di Energy Nature Light Terminal for di Apapa Port to also commission di Integrated National Security and Waterways Protection Infrastructure, AKA Deep Blue Project.

Read full article