BBC Pidgin of Wednesday, 13 October 2021
Source: BBC
COP26 go hold for Scotland dis year and expectations for di event don dey choke.
But wetin e be, who dey go and wetin fit spoil?
Continue dey read for everytin you suppose know about dis latest climate change tok-tok.
Wetin be COP26?
COP - wey mean Conference of Parties - na yearly summit wia 197 kontris go gada to tok how all of us go take handle di mata of climate change.
Na pat of di United Nations Framework Convention on Climate Change wey be international treaty wey all di kontris and territories follow sign to reduce di way human beings take dey scata di planet.
COP26 wey go hold for Glasgow from 1-12 November, na di 26th gathering since dem arrange di treaty for 21 March 1994.
Di COP26 dey important?
Well-well oh.
COP26 go be di first time we go siddon to look our pass or fail mark for di Paris Climate Accord wey we bin sign for 2015.
Dis agreement, Paris Accord na wetin human beings dey plan to prevent di kain climate kasala wey dey come.
For dia, we realise say if global warming continue to rise 1.5C above di temperature we bin het for pre-industry times, we no fit ure di way dis planet go spoil.
So like any plan, you need to actually do di work, so e go work, and na why COP dey important, e be like group meetings wia dem go give evri team member work, and see how far dem do reach for dia task.
So for di Paris jaw-jaw, COP21, dem arrange wetin di goals be to avoid di climate change kasala. di kontris wey sign in agree to,
Dem also gree say evri five years dem go meet to tok which kain progress dem don make. Di first one suppose hold for 2020 but because of di pandemic dem move am to 2021.
Wetin be di different tin wey di pandemic bring?
Di pandemic push di summit by one year but apart from dat, e also shift our brain make we tink how di economy go recover afta covid.
For instance, shey we need to dey fly as we dey fly? Weda work from home fit reduce car emissions? Weda pipo go begin comot urban areas? And so on.
American Presido Joe Biden don already say climate friendly policy go dey top of im priority for im coronavirus economy recovery plan.
And for COP26, oda leaders for around di world go need to set new long term goals to address cliate change.
Wetin COP26 wan achieve?
Plenti tins, first na tins wey dem no finalize for di COP25 wey hold for Madrid.
Kontris bin no gree on top big issues wey dey cause gbege.
For example, na poorer kontris go be di first feel di impact of climate change as rising sea levels don dey sink island kontris and droughts and heatwaves don dey cause crop failures.
So, before COP26, over 100 developing kontris bin demand