You are here: HomeAfricaBBC2022 01 02Article 1436188

BBC Pidgin of Sunday, 2 January 2022

    

Source: BBC

Cape Town parliament fire: Huge fire burn South Africa parliament building

Black smoke dey come out from di roof of di building inside Cape Town Black smoke dey come out from di roof of di building inside Cape Town

Huge fire dey burn for di Houses of Parliament inside South African city of Cape Town.

Video footage show black smokeas e fill di sky, with huge flame wey dey come out from di roof of di building.

Dozens of firefighters dey for di site dey battle di fire; e no dey clear yet wetin cause di fire.

Dis dey happun afta Archbishop Desmond Tutu state funeral for St George Cathedral, near Parliament.

Di roof area bin catch fire and di National Assembly building dey on fire too, the city authorities initially said.

Minister of Public Works Patricia de Lille later tok say dem don quench di fire for di Chamber of di Council of Provinces (dat na di parliament upper house) but di National Assembly building still dey burn.

One member of di Cape Town mayoral committee for safety and security, JP Smith, tell tori pipo say di roof bin partially collapse and di fire detection alarm no bring out sound wen di fire start:

"Di roof of di building don collapsed for one side and di fire spread to di new assembly, according to di officers."

"Dem detect large cracks inside di wall, wey be of serious concern.

"Di firefighters report dem reach di scene of di fire for some time before di fire detection system first trigger and then sound di alert. So e be like say di system dey somehow delayed."

Di parliament no dey currently for session because of di holidays.

Di Houses of Parliament for Cape Town dey made up of three sections, with di oldest wey dey since 1884. Dem build di newer sections wey dey house di National Assembly for di 1920s and 1980s.

Last year, one fire bin burn part of di university of Cape Town Library wey be home to one unique collection of African archives.

Read full article