You are here: HomeAfricaBBC2021 08 31Article 1345189

BBC Pidgin of Tuesday, 31 August 2021

    

Source: BBC

Crate challenge: Wetin be dis challenge wey don go viral?

CrateChallenge na di new social media competition wey go viral across di world CrateChallenge na di new social media competition wey go viral across di world

One new competition wey dem call 'Milk crate challenge' don begin go viral for social media all ova di world.

Di "Milk Crate Challenge" first start for TikTok and now e don dey enta oda social platforms like Twitter and Instagram.

Experts don sama warning say dis new trend wey dey unsafe trend, togeda with di overcrowding of U.S. emergency rooms sake of di COVID-19, and dis na disaster wey dey wait to happen.

For Nigeria, concern citizens don begin dey sama warning give pipo wey dey plan to join di challenge as e be say resident doctors for di kontri dey on strike and Health insurance no dey.

Wetin di Challenge dey all about

Di challenge wey start for United State of America involve climbing up empty milk crates wey dem arrange on top each oda like staircase and e dey dangerous because di participant fit fall.

Di arrangement of di milk crate go dey like pyramid and di participant need to successfully waka form di beginning of one side go reach down of di oda side before dem go win either money pr praise.

Videos of pipo both young and old wey dey partake for dis challenge don full everywhere for social media.

Even funny memes of pipo wey fall or not dey successful to complete di challenge dey trend for internet.

So far for dis new challenge only few pipo don manage to truly climb to di top and complete di pile of empty milk crate wey form di pyramid or staircase.

Some pesin wey don master di act to climb di pyramid dey even use high heels waka through di crate while some de use bicycle take clime sef.

But as di trend dey go viral, a lot of pipo dey concern about di injury wey di stunt fit lead to and some of which be breaking of back, legs arms and odas serious injuries.

Who start di milk crate challenge?

According to Know Your Meme, di milk crate challenge begin over one week ago wen one video wey dem post on 13th August show some pipo inside one park dey try di challenge.

Pipo share di video on Facebook and soon e go viral. E come later enta TikTok and di trend begin.

Read full article