You are here: HomeAfricaBBC2021 08 30Article 1345012

BBC Pidgin of Monday, 30 August 2021

    

Source: BBC

DSS release 8 out of 12 Igboho aides afta 61 days

Di  bin dey under custody since DSS operatives arrest dem in July Di bin dey under custody since DSS operatives arrest dem in July

Eight out of di 12 aides of Sunday Igboho wey DSS arrest some months ago, don dey released.

Leader of di umbrella body of Yoruba Self-Determination Groups, Prof. Banji Akintoye confam dia release giveto BBC Pidgin on Monday.

"Di remaining four still dey custody for offence wey only God sabi... but we go kontinu to fight for dia release."

Professor Banji tok inside statement wey im tok-tok pesin Maxwell Adeleye sign.

Nigeria secret police - Department of State Services [DSS] - bin arrest 12 pipo for one raid for Igboho house for July.

For August, one Federal High Court for Abuja bin grant bail to di detainees wit different-different requirements.

But now e be like eight of dem don meet di demand of di law for Abuja to secure dia release.

Igboho, wey im real name na Sunday Adeyemo, still dey Benin Republic wia im dey face im own legal battle.

Igboho dey fight against goment extradition wey wan bring am back to Nigeria.

Followers of Yoruba Nation, wey be di umbrella joinbodi wey Igboho dey lead, go see dis release from DSS hand, as small victory for dem.

Prof. Banji group Ilana Omo Oodua Worldwide wey don dey fight for Igboho release in Benin give di names of those wey DSS release:

Abdullateef Ademola, Onaolapo, Tajudeen Irinloye, Diekola Jubril Ademola, Ayobami Donald, Uthman Opeyemi Adelabu, Olakunle Oluwapelumi, Raji Kazeem and Taiwo Opeyemi Tajudeen.

Dia 30 August release mark 60 days wey dem don dey di hand of DSS for detention.

Read full article