You are here: HomeAfricaBBC2021 08 30Article 1345036

BBC Pidgin of Monday, 30 August 2021

    

Source: BBC

Ghana Okada rider chop arrest for allegedly beheading teenager for ritual

Random shot of di Volta Region wey dey the kontri's east Random shot of di Volta Region wey dey the kontri's east

Ghana Police Service arrest 25 year old Okada rider, Dovi Tsidi for Volta Region who behead 13 year old boy for rituals.

Residents for Avehime claim say de young man allegedly kill de boy, cut off en head go give one prophetess for ritual money purpose according to residents.

But Police say dem no fit confirm de direct link to ritual money but so far dem arrest three people in connection to dis crime, while one dey at large.

Inspector Prince Dogbatse, Public Relations Officer for Volta Regional Police Command talk BBC Pidgin say:

"We deposit de body of de 13 year old for Bator Hospital Mortuary while dem continue to investigate circumstances leading to de murder".

"De incident happen for Avehime, Central Tongu district around 10.15pm" he talk BBC Pidgin Favour Nunoo.

He explain say Police receive information on Sunday say some murder happen, so upon reaching de scene dem discover de body of de 13 year old.

Police say dem still dey investigate de matter, meanwhile dem dey on manhunt for de fourth suspect who dey on de run.

Read full article