BBC Pidgin of Thursday, 23 February 2023
Source: BBC
TV reporter Dylan Lyons, 24, and one nine-year-old girl have been fatally shot near Orlando, Florida, close to the scene of a murder that took place hours earlier.
Di same gunman, wey be suspect for di oda homicide also shoot and injure one second reporter, Jesse Walden, and di mama of di girl.
Di journalists bin dey cover di killing of one woman wen di teenage suspect return, police tok.
E no dey clear if dem be di target.
Di suspect bin dey armed wen dem arrest am and im bin no dey co-operate wit police, investigators tok.
Dem neva fit identify di oda two victims for di two attack wey happun on Wednesday for Pine Hills, one suburb west of Orlando.
For one news conference, Orange County Sheriff John Mina say di journalists bin dey "in or near dia motor", wia im tok say no look like TV station official motor, wen dem attack dem at around 16:00 local time (22:00 GMT).
E tok say di Spectrum News 13 journalists bin dey report on a shooting wey happun earlier in di day at around 11:00 local time, wey see one woman for her 20s wey dem fatally shoot inside one car, wen di suspect return to di crime scene and open fire.
Afta e attack di journalists, di alleged gunman - Keith Moses, 19 – bin go into a nearby home and shoot di girl and her mama, di sheriff tok.
Di mama dey hospital for one critical condition, e add.
Oda journalists nearby help provide first aid to di victims, according to local reporters.
This is 19-year-old Keith Melvin Moses, the suspect in a series of shootings today that left three dead, in OCSO custody. This is a sad day for our community. Three were murdered today, including a woman in her 20s, a 9-year-old girl and a @MyNews13 employee. pic.twitter.com/DXXkxzRHl5
— Orange County Sheriff's Office (@OrangeCoSheriff) February 23, 2023