BBC Pidgin of Sunday, 19 February 2023
Source: BBC
From frying akara to eating for local restaurants or making pipo hair, na some of di gimmicks politicians dey employ to woo electorate wen elections dey near.
Dem dey do some funny things wey normally dem no go do to make ordinary pipo reason say dem be like dem.
As di 2023 general elections dey near, di mata no different as politicians don dey apply dia normal gimmicks. Although, dis year own different small.
Apart from dia well-written manifestoes plus dia fake campaign promises, dem don dey enta market, go slum, attend different kind meetings, parties and ceremonies wey normally dem go either send representative or make dem no show at all.
Dis na some of di pressures wey some di candidates wey dey contest for different elective posts dey apply to win di 2023 elections.
Dancing to 'Buga song'
Okay, some requested for him to stand and dance. Now, due to popular demand by his detractors who are having buckets of tears since morning, we serve you the ‘standing version’ of the dancing CITY BOY!! For those who are depressed by his fitness, we say, ‘it is what it is!!’
Read full article