You are here: HomeAfricaBBC2021 07 08Article 1304872

BBC Pidgin of Thursday, 8 July 2021

    

Source: BBC

Imo State House of Assembly witness gunshots after suspension of lawmakers - See wetin we know

Di front of Imo State House of Assembly building Di front of Imo State House of Assembly building

Lawmakers inside di Imo State House of Assembly hear plenty gunshots after di Speaker announce suspension for former house leader Uche Ogbuagu, and five members.

One video wey dey circulate show lawmakers from di eastern state of Nigeria inside building, as gunshots begin fire nearby. Dis one cause small commotion among di lawmakers.

Earlier, Speaker of di House, Hon. Paul Emeziem bin don announce di suspension of six members ontop dia "unparliamentary conduct".

Di suspended members be: Uche Ogbuagu (Ikeduru LGA), Barrister Anyadike (Ezinihitte LGA), Ezerioha Dominic (Oru West LGA), Philip Ejiogu (Owerri North LGA), Micheal Onyemaechi (Ihitte Uboma LGA), Kennedy Ibe (Obowo LGA).

Meanwhile dem comot Arthur Egwim as Chief Whip of di Assembly join while Obinna Okwara, member representing Nkwerre replace am.All oda standing committees for di House don dey dissolved, local reports bin tok.

BBC never fit confam weda say na thugs shoot or di aide to di lawmakers to maintain decorum afta di announcement of di suspension.

Read full article