BBC Pidgin of Monday, 2 May 2022
Source: BBC
Dust storm don turn Iraq sky to orange colour, as one strong wind of dust hit large parts of di kontri.
Flights dey on stand still for airports for Baghdad and Najaf airports due to poor visibility.
Weather forecasters or weather sabi pipo say dem expect di condition to continue today Monday.
Dust storms don dey dey more common for di Middle East.
And sabi pipo dey blame am on combination of climate change and mismanagement of land and water.
For some places for Iraq on Saturday, you no fit see pass 500 metres.
Iraq bin experience dust storms at different times last month.