You are here: HomeAfricaBBC2021 07 21Article 1314460

BBC Pidgin of Wednesday, 21 July 2021

    

Source: BBC

Jacob Zuma trial: How former South Africa president attend im virtual corruption trial from jail

Mr Zuma (left) dey face charges of fraud and racketeering wey date back to di 1990s Mr Zuma (left) dey face charges of fraud and racketeering wey date back to di 1990s

South Africa former president Jacob Zuma don appear on a video link from prison to attend one corruption trial.

Mr Zuma dey face charges of fraud and racketeering wey date back to di 1990s.

Dis an di first time dem go see am since dem send am to jail for contempt of court - move wey spark one week of looting and katakata for South Africa.

E bin siddon quietly inside one big office chair for one prison room.

E wear dark suit and red tie, and only tok small as im lawyer argue for another postponement of im corruption trial.

Di hearing hapun online - sake of di pandemic and security concerns.

Mr Zuma now don spend more dan one week for prison afta dem find am guilty of contempt of court, say im refuse to participate inside anoda separate corruption case.

Di decision to sentence Mr Zuma to 15 months in jail spark protests wey quickly turn violent - leading to more dan 200 deaths, and plenti looting and katakata.

Read full article