You are here: HomeAfricaBBC2021 08 16Article 1333795

BBC Pidgin of Monday, 16 August 2021

    

Source: BBC

Jos: Plateau state accident survivor narrate how keke rider save e life

Police bin sent to restore calm after di incident Police bin sent to restore calm after di incident

On Saturday, one convoy of buses bin suffer attack by mob wey attack Muslims wey dey return to southern Nigeria from northern city of Bauchi.

Di 23-pipo wey dem kill bin go attend religious ceremony to mark Islamic new year.

Muhammad Ibrahim na one of di survivors from di killings on Saturday for Plateau state (central Nigeria) and e tell BBC say if not for one keke rider, dem for count am among di dead by now.

Muhammad say im and many oda travellers dey come back to Jos (capital of Plateau state) after dem go celebrate di new Islamic year for Bauchi state with Islamic cleric Dahiru Bauchi na im dem jam serious traffic for Gada Biyu area.

"At first we tink say na just normal traffic as a result of tanker wey fall or something but before we know we just start to dey see pipo to throw heavy stones at our car, I no even know how I take use window comot."

"Na after I fall down I just see one keke rider wey shout say make I quickly enter and na so I sharpaly jump in na wetin save me be dat.

"Before then I use my eye see how di attackers dey beat and use stone crush pipo."

Muhammad say e escape with minor injuries but Saturday na day wey e no go ever forget because of di horror and how e almost die.

At di moment, di state goment don put curfew for three local goment areas of di state - Jos north, Jos south and Bass - after wetin happun and many residents dey indoors.

Management of University of Jos don also suspend exams for di school.

But di institution warn di students to remain for dia hostel for dia safety until di school management give another directive.

View this post on Instagram

A post shared by Ahmed Musa MON (@ahmedmusa718)




Sani Adamu na resident of Jos city and e tell BBC say since Saturday him and im family no dey go anywhere because e no know wetin fit happun.

Over di years Plateau don suffer plenti attacks wey lead to several loss of life and properties.

For one of di most memorable one wey happun for 2010 hundreds of pipo die and many properties destroy when clash break out on 17th January and spread to different towns for di state.

Read full article