You are here: HomeAfricaBBC2023 10 09Article 1859252

BBC Pidgin of Monday, 9 October 2023

    

Source: BBC

Judgement day for police officer wey allegedly shoot and kill lawyer Bolanle Raheem on Christmas day

Police officer Vandi Dramdi dey accused of shooting Bolanle Raheem Police officer Vandi Dramdi dey accused of shooting Bolanle Raheem

One Lagos High court go on Monday deliver judgement ontop di case of Vandi Dramdi, di police officer wey dey face accuse of shooting and killing a Lagos based lawyer Omobolanle Raheem on Christmas day.

Di judgement go take place on Monday for Lagos following different previous court appearances of Vandi and oda witnesses.

Na for 25 December 2022 officer Vandi allegedly shoot and kill di Lagos lawyer Bolanle Raheem.

Raheem and her family bin dey return from Christmas service wen di incident happun. Di incident happun around Ajah under bridge.

Tori be say her husband na im bin dey drive, Barr. Omobolanle sit for front wit her husband. Di officer ask dem to park and dem bin dey try park well, wen suddenly, di police officer shoot at close range right into her chest.

Barrister Omobolanle Raheem husband tori wetin happun

Di husband of di lawyer wey one Assistant Superintendent of Police, Dambri Vandi shoot im wife for Ajah, Lagos state on Sunday, 25 December tok say im and im wife and dia children plus oda family members bin dey come from church wen di incident happun.

Oga Raheem say on dia way from church, dem decide to go jolly.

Dem bin go one supermarket for Abraham Adesanya buy Ice-Cream, dem later go get pizza, na as dem dey go house, di incident occur.

“As we comot di place, we come dey go towards Ajah to go do U-turn to come back Abraham Adesanya. Wen we take di U-turn, we see policemen dey stop some vehicles. As we approach dem, dem say make we stop, and for di process, we hear one loud sound on my wife side window. All of a sudden, I see blood dey comot from her chest.

“I immediately run out; my sister-in-law, wey dey wit us also run out and hold di policeman; e cock im gun to shoot her too.

"E no make sense to follow am tok, so I go see if e get anytin wey I fit do to help my wife; I see as she dey struggle for breath, and by dat time, my sister-in-law don bring di policeman into di car and don push am to di front seat.

“We drive go one hospital but dem say dem no fit handle am; we later carry her go Grandville Hospital, where dem confam her dead."

How Lagos state file murder charge against officer Vandi

For December 2022, Lagos State Attorney-General, Moyosore Onigbanjo, SAN, bin file a one-count charge against ASP Drambi Vandi for di murder of Mrs Bolanle Raheem.

E file am wen Vandi appear before di Chief Magistrate Court, Yaba.

Di charge read say, “Dat you ASP Drambi Vandi on di 25th day of December 2022, for Ajah Road, along the Lekki Expressway, Lagos, unlawfully kill one Omobolanle Raheem by shooting am for her chest contrary to Section 223 of di Criminal Law of Lagos State 2015.”

With di charge, di Attorney General, apply say make dem officer Vandi pursuant to Section 264 of di Administration of Criminal Justice Law of Lagos, 2015.

E tell di Chief Magistrate, Miss Adeola Olatunbosun say di basis for di remand is to allow di police conclude dia investigations into di mata.

Di magistrate grant di request to remand di defendant for di Ikoyi Correctional Centre and order say make di case file dey duplicated and sent to di Director of Public Prosecution, Dr. Jide Martins for legal advice.

Di tragic tori on a christmas day catch di attention of di kontri and make pipo call for justice.

Di den Nigeria Inspector General of Police Usman Alkali Baba recommend di immediate suspension of di Assistant Superintendent of Police, Vandi,

Di tori even catch di attention of former President Muhammadu Buhari.

Buhari wey condemn di killing bin direct di police authorities to "take di strongest possible action" against di culprits wey dey detention.

Read full article