You are here: HomeAfricaBBC2022 09 30Article 1633343

BBC Pidgin of Friday, 30 September 2022

    

Source: BBC

Kabul blast: At least 19 pipo don die afta one blast hit Kabul education centre - police

Footage for local TV wey dem share for social media appear to show scenes from a nearby hospital Footage for local TV wey dem share for social media appear to show scenes from a nearby hospital

Police for Kabul say suicide blast for one education centre for di Afghan capital don kill at least 19 pipo and injure many odas.

Di blast take place for di Kaaj education centre for di Dashte Barchi area for di west of di city.

Students bin don dey siddon practice university exam, officials from di centre said.

Many of those wey dey live for di area na from di Hazara minority, wey don dey targeted in di past attacks.

No group don say dem dey behind di blast. But Shiite Hazaras don for decades now don face persecution from both di Taliban and di rival Islamic State group.

Several blasts don happun for di Dashte Barchi region - wey be mainly a Shiite Muslim area - for recent years, with di attacks wey dey often target areas like schools and hospitals.

On Friday, di Taliban interior ministry spokesman say security teams dey di site and condemn di attack.

Abdul Nafy Takor say attacking civilian targets "prove say di enemy dey inhuman cruelty and lack of moral standards."

Di Taliban return to power for Afghanistan last August and di group say dem dey attempting to restore stability.

However attacks by rival Islamists di Islamic State group don continue. Afghanistan Hazara community dey often dey targeted by Sunni militant groups, including IS.

Prior to di Taliban return last year, bomb attack on a girls school for di Dashte Barchi region kill at least 85 pipo - mainly students- and injure hundreds more.

Read full article