You are here: HomeAfricaBBC2022 08 23Article 1608290

BBC Pidgin of Tuesday, 23 August 2022

    

Source: BBC

Key points Odinga submit to challenge William Ruto win for Supreme Court

Raila Odinga, carry second for Kenya presidential election Raila Odinga, carry second for Kenya presidential election

Raila Odinga, wey carry second for Kenya presidential election go court on Monday to challenge di August 9 election result, wey e describe as "fraudulent".

For im 70-page legal argument, Odinga allege say pre-planned effort dey to change di outcome.

According to di electoral commission, oga Odinga take 48.8% of di vote, losing to William Ruto 50.5%.

One independent monitoring organisation say di commission final result dey in line wit im own projection.

However, four of di seven electoral commissioners refuse to endorse di outcome, alleging say di way dem tally di final result no "clear".

Di seven judges for di Supreme Court get 14 days to rule on di matter.

Crowds of Odinga supporters sing and chant outside di court for di interior part of di capital, Nairobi, as di presidential candidate arrive to deliver di document, along wit dozens of boxes of evidence.

Im legal petition, one of more dan five weu im hand over, describe di alleged attempt to alter di final result as "premeditated, unlawful and criminal".

Oda points Odinga submit to challenge William Ruto win for Supreme Court

Raila Odinga also:

- Call Independent Electoral and Boundaries Commission (IEBC) chairperson Wafula Chebukati "rogue"

- Allege say e involve for plan to "secure fraudulent result"

- Say oga Ruto dey aware of di plan but e no provide evidence to back am up

-Raise question about di tallying process

- Say dem tamper wit evidence of di results from some polling stations
Argues that the voter turnout figure was manipulated so Mr Ruto did not have to go into a second-round run-off

Neither Ruto nor Chebukati don respond to di allegations.

As e dey handover di petition for di Supreme Court, Odinga say "corruption cartels" dey take democracy for granted, but e tok who e dey refer to.

Dis na di fifth time wey di 77 year old dey contest for president. Previously im be opposition candidate, but dis time di outgoing president Uhuru Kenyatta.

For di third time in a row e don go court to make sure say dem cancel di election.

For 2017, veteran politician successfully challenge di result of dat year presidential election, wey e lose oga Kenyatta, and di Supreme Court order re-run. Di case highlight logistical issues in di way dem take collate di result.

However, for 2013 court dismiss im challenge.

Dis time DI IEBC try to make di results process as transparent as possible by publishing di polling station tallies as soon as possible.

Di independent Elections Observation Group do dia own tally and say dia estimate dey consistent wit wetin di electoral commission publish.

Read full article