You are here: HomeAfricaBBC2023 07 09Article 1800782

BBC Pidgin of Sunday, 9 July 2023

    

Source: BBC

May Yul-Edochie finally tok for di first time afta di death of her 16-year-old son

May Yul Edochie tok about im son May Yul Edochie tok about im son

Wife of Nigeria Ogbonge Nollywood actor, Yul Edochie, don finally tok for public for di first time since her pikin die.

May Edochie lost her first son wit Yul, Kambilinachukwu three months ago.

Di 16 years bin slump wia im bin dey play footballfor school.

Since Kambili death, May bin remain quiet no tok anytin. But she don finally break her silence wit di post wey she do for her Instagram page on Saturday.

She tank all di pipo – family, friends plus well wishers from around di world wey show she and her family love for dia trying time as she try to find words to mourn her pikin.

She write: “Words no dey enough to express our gratitude to you all. In all of di trials, we believe say dis immeasurable loss na heaven gain.

“Wen you lose husband, dem go call you widow…..

View this post on Instagram

A post shared by May Yul-Edochie (@mayyuledochie)



“Apart from “vilomah” wey mean “against natural oder”, I no fit find any English word for pesin wey lose im pikin. I no sure say death strong and painful like loosing pikin. We still dey inexpressible grief, however, I want all of una to know say wey dey fine by God special grace.

“Indeed di uncertainty of tomorrow remain mystery and some kain tins wey occur dey unforgettable but we just gatz find way to live wit dem no matter how painful and difficult dem dey.

May Edochie go on to add say her family and friends na her “great pillar” and dem bin help her through di process.

She conclude by saying: “E dey impossible to forget a child so im go always remain di second of my four adorable children.”

Before dia son death, May and Yul bin no too dey good term for dia marriage following di actor love announcement say e don marry anoda wife, wey also be actress, Judy - dem both get one son together.

Plenti pipo bin chook mouths for di mata sotey dem drag Yul and Judy dat time - di dragging continue enter anoda level after di death of di actor first son.

Yul and im first wife bin get oda two more pikin- one girl wey be university undegraduate and a younger son.

Read full article