You are here: HomeAfricaBBC2021 11 22Article 1407331

BBC Pidgin of Monday, 22 November 2021

    

Source: BBC

Nigeria: WAEC seize thousands students result from di 2021 exams

WAEC is the main terminal exams body for Junior and Senior High Schools in Ghana WAEC is the main terminal exams body for Junior and Senior High Schools in Ghana

Di west African examination dis year end for October 8, 2021 and today, Monday, November 22, 2021 - 45 days afta di last paper, authorities release candidates result but thousands of candidates no go fit see dia own now sake of WAEC don seize am.

According to di statement wey dem release, results of 170,146 candidates, wey be 10.9% of di total number of candidates wey write di exam still dey wit WAEC sake of connect wit orisirisi case of exam malpractice.

Di exam join bodi say di tin wey dey worry dem be activities of rogue-website operators and some oda social media platforms, wey dey post exam questions online immediately afta di di paper dey administered.

Plus pipo wey dey use phone for exam hall despite say e dey banned. And some schools dey arrange organized cheating, plus oda big matter.

Di exam bodi say dem dey investigate all di case and reports of di investigations go dey presented to di right Committee of di Council to reason am kia kia.

Di Committee decision go dey communicated to di affected candidates through dia schools.

How many candidates bin register and how many siddon write exam?

According to WAEC, 1,573,849 candidates bin register for di exam from 19,425 secondary schools wey gomment sabi for di kontri.

1,560,261 candidates bin siddon write di exam.

Some candidates from some schools from Benin Republic and Cote d'Ivoire, wia Nigeria curriculum for Senior Secondary School dey use also follow write di exam.

Schools for Equatorial Guinea no present candidates for di exam sake of COVID-19 wahala, WAEC add.

Di statement also tok say Analysis of di statistics of how candidates perform for di exam show say, out of 1,560,261 candidates wey write di exam,

1,398,370 candidates, wey be 89.62%, gbab credit and above for minimum of any five subjects.

Dis one mean say e fit be wit or without English Language and Mathematics or one of di two ogbonge subjects.

1,274,784 candidates, wey be 81.7%, gbab credits and above for minimum of five subjects, including English Language and Mathematics.

Women no carry last for dis year WAEC.

630,138 wey be 49.43% be male candidates.

644,646) wey be 50.57% be female candidates.

Di exam join bodi say di percentage of candidates wey dey dis category for WASSCE for School Candidates, 2020, dat is, pipo wey gbab credit and above for minimum of five subjects, including English Language and Mathematics, be 65.24%. Dis one na appreciable 16.46% improvement for performance.

Read full article