You are here: HomeAfricaBBC2021 07 07Article 1303423

BBC Pidgin of Wednesday, 7 July 2021

    

Source: BBC

Nigeria prez praise 'professional way' security agencies handle separatists Igboho, Nnamdi Kanu

Nigeria President Muhammadu Buhari Nigeria President Muhammadu Buhari

Nigeria president Muhammadu Buhari don hail di professional way security agencies handle di arrest of Nnamdi Kanu and raid of yoruba activist, Sunday Adeyemo house on Thursday.

For inside statement, President Buhari say di acts of di security agents "must be commended" and dem suppose "sustain dis level of professionalism".

Dis comments by di President dey come days afta Nigeria Minister of Justice, Abubakar Malami announce di arrest of Kanu wey be di leader of di ban Indigenous People of Biafra.

Days afta Kanu arrest, Nigeria secret police - Department of State Services - carry out raid for di home of Yoruba activist, Sunday Adeyemo alias Sunday Igboho.

Dem allege say im get weapons and since don declare am wanted. Im lawyer don since deny di accuse and demand 500 million naira compensation.

President Buhari through im Media aide, Garba Shehu wey release di statement claim say Igboho na "militant ethnic Secessionist, wey also bin dey conduct acts of terror and disturbing di peace under di guise of protecting fellow 'kinsmen'."

Read full article