You are here: HomeAfricaBBC2021 09 16Article 1358422

BBC Pidgin of Thursday, 16 September 2021

    

Source: BBC

Nigeria's University of Benin close down immediately as students protest

Aerial shot of di engtrance to UNIBEN Aerial shot of di engtrance to UNIBEN

Vice Chancellor of di University of Benin for Edo state, Central Nigeria Prof. Lilian Imuentinyan Salami don approve di immediate closure of di University.

Dis development dey come one day afta di students block di major Lagos-Benin expressway to protest increase in school fees on Tuesday.

Di Vice Chancellor for inside statement wey di Registrar sign say dem take di decision to close di school afta due consultation and in di best interest of di general student's body and according to her, dis dey based on security reports to avoid make hoodlums no hijack di student's protest, make e no go lead to breakdown of law and order.

Prof. Lilian Salami order make all students vacate di hostels and University premises not later than 12 noon on Wednesday 15th, September, 2021.

She add join say she don review di agitation of di student's wey dey di I no gree.

On Tuesday, University of Benin students bin enta road to protest di N20,000 school management put on top dia school fees as penalty for late payment.

For di Ekheuan campus of di institution, di students say dem block di road to protest against di "indiscriminate increment of their school fees."

Di Benin-Lagos Expressway also dey blocked for hours by di protesting students for di Ugbowo campus of di university wey make am dey hard for pipo to pass.

Di students wey carry placards wey carry different write ups like 'Federal Uni don turn BOWEN', 'UNIBEN no be BOWEN, urgent 20k no be our budget', 'Oppression comes in different forms', and 'We didn't sign for this injustice', bin play solidarity songs wit public address system.

Read full article