You are here: HomeAfricaBBC2021 07 08Article 1304869

BBC Pidgin of Thursday, 8 July 2021

    

Source: BBC

Nnamdi Kanu: Over 50 lawyers go appear for Biafra separatist leader in court

Combination foto of Nnamdi Kanu plus Attorney General, Abubakar Malami Combination foto of Nnamdi Kanu plus Attorney General, Abubakar Malami

Over fifty lawyers na im go appear to defend di leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob) Nnamdi Kanu for court, im Lawyer Ifeanyi Ejiofor tell BBC Pidgin.

Ejiofor tok dis wen im dey confirm di tori say di Ipob leader go soon get bail from detention.

"We dey very certain say Mazi Nnamdi Kanu go soon come out of detention. Na one thing to make allegations and na anoda thing to establish those allegation.

"Federal goment no fit come say Kanu jump bail wen everybody know wetin happen for im house. How dem want take tok say im jump bail.

"We go file application for di bail of Nnamdi Kanu once di trial begin on di 26 of July," Ejiofor tok.

Nigeria keep Nnamdi Kanu for dia secret police [DSS] custody as pesin of interest until 26 July wen im court trial on criminal charges go resume.

Di number of Lawyers wey go represent Nnamdi Kanu

Im say over fifty Lawyers wey get beta understanding about dis matter n aim go dey court to defend Kanu.

Ejiofor say Lawyers na both from Nigeria and abroad.

According to di Lawyer, "We get very sophisticated Lawyers wey go represent Nnamdi Kanu for di matter. We get more dan 50 Lawyers wey go represent Kanu and some of di Lawyers dey come from Isreal, Europe and oda part of di world.

"By di time we apply for di bail and court no gree we go carry our appeal go higher court. We go exhaust all constitutional means to get our client out of detention."

Is Nnamdi Kanu alive?

Ifeanyi Ejiofor say him client Nnamdi Kanu still dey detention even though im health dey go bad.

Im tok say Kanu need medical attention wey im clients dey believe sey im go get.

"Im conditio still dey bad and im need urgent medical attention. We don already dey take steps to ensure sey dat one happen within di shortest possible tim," Ejiofor tok.

Lord Alton present Nnamdi Kanu matter for UK Parliament

Member of UK Parliament Lord David Alton don present Nnamdi Kanu matter for di parliament.

Lord Alton dey ask whether di British goment dey aware of di Ipob leader and whether im dey get assistance from di British embassy for Nigeria.

Di MP tell BBC say im make di presentation to get answer whether di arrest of Nnamdi Kanu follow international procedures.

"Di method wey Nigeria goment take arrest Kanu no clear," Lord Alton tok.

Di Uk Parliament go answer Lord Alton questions about Nnamdi Kanu matter on July 19, seven days to di Ipob leader trial for Nigeria.

Read full article