You are here: HomeAfricaBBC2021 11 03Article 1393822

BBC Pidgin of Wednesday, 3 November 2021

    

Source: BBC

Obi Cubana: Profile of di Nigeria business mogul wey get corruption wahala

Obi Cubana im real name na Pascal Chibuike Okechukwu Obi Cubana im real name na Pascal Chibuike Okechukwu

Di Economic Financial Crimes Commission EFCC say Obinna Iyiegbu wey many pipo sabi as Obi Cubana still dey wit dem.

Dis dey come afta tori begin spread on Tuesday say e don dey released.

Di Nigeria corruption police later clear di mata to BBC Pidgin for Tuesday evening say Obi Cubana still dey dia office.

Earlier in di day, one message from im verified Instagram account add to di tori wey fly up and down say e EFCC don free am.

Di message read as "Okpataozuore! I love you all! Unbroken!" bin generate thousands of comments few minutes afta e dey posted.

Plenty pipo wey react to di post including celebrities wey show am love and support wit dia comments.

When BBC Pidgin confam Obi Cubana PA to confam if true-true e don dey release, she say she no fit comment on di mata.

Na on Monday, Obi Cubana show for EFCC office.

According to one source from di agency, e tell BBC Pidgin say dem no arrest Obi Cubana as tori pipo bin report as na only di business man come dia office by imsef afta di commission invite am;

"We no arrest Obi Cubana. We don bin invite am come our office two weeks ago and e show up just yesterday around 11: AM by imsef for our office wey dey Wuse Zone 6 Abuja," di source tok.

Di source inside EFCC say dem dey investigate Obi Cubana for Evasion of Tax by di Cubana group.

Oda charges wey dem dey torchlight di business man for na; Money Laundering and Abuse of di Naira in public places.

E no dey clear if di abuse of di naira charges dey related to di spraying of money wey happun during di burial of di mama of Obi Cubana for July dis year.

Seven things to sabi about Obi Cubana

Obinna Iyiegbu aka Obi Cubana na businessman, entertainer, entrepreneur plus philanthropist dey for di custody of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).

  • Oga Iyiegbu na di chairman and owner of di popular Cabana groups.


  • E enta limelight during di burial of ceremony of im mama, Mrs Uche Mabel Uyiegbu wey take place for im home town for Oba, Idemili South Local Goment Area of Anambra State.


  • Di 46-year old business man dey into entertainment and hospitality business. Dem born am for 12 April 1975.


  • Di political science graduate make im first one million naira for 1999 during im National Youth Service Corp (NYSC) scheme.


  • Oga Iyiegbu career as businessman start for 2006 wen e establish one Nite Club for Abuja. E later build anoda hospitality club e call Cubana for Owerri for Imo state and get multiple businesses from there.


  • E be family man: Obi Cubana dey married to Ebele Iyiegbu and dem get children together.


  • Believer in God: From im post on social media and di interview e get wit BBC Pidgin, Obi Cubana come across as pesin wey believe in God as e say "Prayer, consistency in handiwork, human connections wit pipo, na di road of success."


  • Read full article