You are here: HomeAfricaBBC2021 09 17Article 1359784

BBC Pidgin of Friday, 17 September 2021

    

Source: BBC

Resident doctors strike in Nigeria: Court rule say doctors NARD end dia strike

Di strike by di resident doctors dey affect hospitals and patients Di strike by di resident doctors dey affect hospitals and patients

Latest news on resident doctors strike be say Justice Bashar Attahiru Alkali of di National Industrial Court don rule say make all di National Association of Resident Doctors NARD end their strike and return to work immediately.

Dem say make di strike end pending di determination of di substantive suit.

Di strike action of di Nigerian Resident Doctors (NARD) don cause major gbege on medical services in gomment hospitals across di kontri .

More details dey come.

Read full article