You are here: HomeAfricaBBC2021 07 08Article 1304860

BBC Pidgin of Thursday, 8 July 2021

    

Source: BBC

Sergio Ramos transfer: PSG sign Spanish defender afta im leave Real Madrid

Sergio Ramos agree to stay wit PSG until 2023 Sergio Ramos agree to stay wit PSG until 2023

Paris Saint-Germain don announce di signing of former Real Madrid defender, Sergio Ramos.

Ramos deal wit PSG na for two years.

Di Spanish defender bin comot from Real Madrid afta im refuse to extend im contract wit di Spanish club.

Manchester United, Chelsea and many clubs for Europe bin bid to sign di defender.

Di influential defender complete im transfer afta e undergo successful medical for Paris on Tuesday.

Di new deal go see Sergio Ramos stay wit PSG until 2023.

Sergio Ramos na di third player wey PSG dey sign dis summer afta dem sign Georginio Wijnaldum from Liverpool and Achraf Hakimi from Inter Milan. Dem also dey linked to signing Italy goalkeper Gianluigi Donnarumma.

"I dey very to join Paris Saint-Germain. Dis na big change for my life and na new challenge wey I no go forget", Sergio Ramos tok afta signing im contract.

Read full article