You are here: HomeAfricaBBC2021 08 20Article 1337245

BBC Pidgin of Friday, 20 August 2021

    

Source: BBC

Taliban dey search pipo wey work wit foreign allies and di former Afghan goment

Taliban take over di kontri weeks after US begin troop pullout Taliban take over di kontri weeks after US begin troop pullout

One United Nations document dey report say, Taliban don increase dia search for pipo wey bin work for Nato forces or di former Afghanistan goment.

Di report say di militants dey go door-to-door to find dia target plus threaten dia family members.

Since di Islamic group takeover goment on Sunday, 15 August, dem try assure Afghanistan pipo say dem promise dem no go take "revenge."

But fear dey grow say big gap dey between wetin dem tok and wetin dem dey do.

Di warning say di group dey target pipo wey collabo wit foreign power and di former goment, come from report intelligence wey di RHIPTO Norwegian Center for Global Analyses gada give di United Nations.

Christian Nellemann, di pesin wey head di group wey do di report tell BBC say: "Right now e get plenty pipo wey Taliban dey target and di threat clear well-well."

"Dem put am for writing say, unless dem surrender, di Taliban go arrest dem cari dem go court, interrogate and punish dia family members on dia behalf.

Oga Christian warn say any pesin wey dey Taliban blacklist dey for serious danger, and dem fit do mass killing."

Foreign kontris still dey try cari dia kontri men comot from di Afghanistan. one Nato official say so far dem don evacute more dan 18,000 pipo from Kabul airport inside five days.

Read full article