You are here: HomeAfricaBBC2021 07 15Article 1309576

BBC Pidgin of Thursday, 15 July 2021

    

Source: BBC

Traders shutdown Ladipo spare parts market for Lagos in protest to killing

Traders for di market bin clash wit pipo believed to be sojas na so di authorities close di market Traders for di market bin clash wit pipo believed to be sojas na so di authorities close di market

Authorities don shutdown di Ladipo Spare Parts Market for Lagos Nigeria.

Traders for di market bin clash wit pipo believed to be sojas but e no dey clear why dem clash.

One market official tell BBC Pidgin say one pesin die while three odas dey hospital.

Dem close down di spare parts market in protest to di shooting incident wey happun dia on Tuesday 14 July, 2021.

Di traders first gather Wednesday morning do prayers and meeting but later decide to shutdown di market to protest di incident.

One market official Chief Emmanuel Mbamara tell BBC Pidgin say one pesin die while three pipo dey fight for dia lives for hospital.

"One pesin dey coma, anoda one do surgery from di bullet wound wey e get from di incident" Na so Mr Mbamara tok.

Tori comot for social media on Tuesday say army pipo dey clash wit traders for Ladipo market Lagos, but di traders say dem no attack di soldiers.

Dem say one customer return goods wey e buy and demand to change am.

But di tok no go down well with di seller wey make di customer go bring in armed men on military uniform.

Ajuluchukwu Ezeanya wey be trader tell BBC Pidgin say "di armed men enta di market begin attack traders and beating dem.

"Dem beginning shoot evriwia wey make bullet hit some of our boys". Ezeanya add.

Tori be say di armed men come from di Nigeria Air Force.

Tok tok pesin of di air force Gabriel Gebkwet tell tori pipo di nation say dem receive distress call say one trader and soldier get misunderstanding for di market.

Say wen dem reach di market traders begin attack dia officers and dey throw dem stones. E say dem dey investigate di incident.

As at press time all gates into di Ladipo market dey shutdown.

Read full article