You are here: HomeAfricaBBC2022 08 19Article 1606082

BBC Pidgin of Friday, 19 August 2022

    

Source: BBC

Wetin Ruto, Odinga, President Kenyatta tok with US senator Coon

File photo File photo

Kenyan President-elect William Ruto and im main opponent for di recent election Raila Odinga meet with US Senator Chris Coon.

Senator Coons bin dey on five-kontri African tour wey im visit dis ogas dem for Kenya.

Di US also praise President Kenyatta for making sure say peace and order dey during di election.

Wetin William Ruto discuss with Senator Coons

Kenyan President-elect William Ruto tweet about di tok-tok wey im do with Congressional Delegation from di United States wey Delaware Senator Chris Andrew Coons lead come in di company of US Ambassador to Kenya.

Di tok wey hold for Nairobi county touch on di just concluded elections for di kontri, Ruto tok.

And also areas of cooperation between Kenya and United States.

Ruto say dem dey committed to deepen relations and further partnership for di mutual benefit of di citizens of di two kontries(US and Kenya).


Also, US Embassy Nairobi tweet say dem discuss di US – Kenya strategic partnership, promotion of peace and security for di region and ways to strengthen di economies of di two kontri.