You are here: HomeAfricaBBC2023 03 29Article 1740005

BBC Pidgin of Wednesday, 29 March 2023

    

Source: BBC

Who be di 38-year-old Nigerian wey buy 55 percent of Danish football club

38-year-old Nigerian man Shola Akinlade 38-year-old Nigerian man Shola Akinlade

One 38-year-old Nigerian man Shola Akinlade don become di new owner of Danish football club Aarhus Fremad afta im buy 55 percent stake for di second division club.

Akinlade na di co-founder of Paystack and owner of Sporting Lagos FC, one professional club wey im establish for 2022.

Aarhus Fremad no disclose how much Akinlade buy 55 percent of di club ownership.

Di IT entrepreneur say im dey honoured and excited on dis new chapter wit Aarhus Frmad.

Dem found Aarhus Fremad for 1947 and di club dey play for Danish second division, wey be di third tier of di Danish football league system.

Di club currently dey top of di Danish second division wit six points clear and e dey on course for promotion to top division at di end of di season.

Akinlade say im get confidence in Lars Kruse to continue as di chief executive of di club.

Wetin di acquisition mean for Nigerian football?

Akinlade say dis acquisition go continue Lagos Sporting commitment to engage and empower local communities.

Di IT entrepreneur say by strengthening di relationship between Sporting Lagos and Aarhus Fremad, dem aim to create environment wey go foster education, growth and opportunity for dia players and di community.

Kruse say Akinlade bin don get di interest to buy club for Europe so dat im players for Nigeria go get opportunity to go Europe on time.

Di CEO also tok say Fremad go help Sporting Lagos to build up some sporting principles and set up academy.

“Na exciting process from wen I first hear say dem spot us all di way from Nigeria. E dey fantastic say pipo wit di right mindset dey wey see football as catalyst for many oda tins - and in terms of values, Sporting Lagos na Nigerian Aarhus Fremad,” Kruse tok.