BBC Pidgin of Friday, 5 May 2023
Source: BBC
“I no see need to come back to Nigeria na why I choose to remain for Sudan despite di war, as I dey tok to you now, I dey market and tins dey move normal for my side.”
Dat na how Masters degree student Badamasi Adam Muhammad begin im chat with BBC Pidgin from im base for Gazira state inside Sudan.
Di Sudan army and di paramilitary Rapid Support Forces (RSF) fight for weeks now don kill ova 400 pipo as two powerful generals dey fight over di future of di kontri.
Badamasi wey dey Sudan since 2015 say e remain one semester for am to finish im Masters program for Holy Quran University Gazira and im mission na to finish every before e set foot for Nigeria.
“Life dey move normal for here and dis na why e get many Nigerians wey run from Khartoum and dey stay with us for here.”
“Wen di kata kata start, I bin call my family for Nigeria tell dem say make dem no disturb themselves say wia I dey dey safe.”
“Dat na why dem no dey disturb demselves over my mata.”
Badamasi say e get Nigerians with families wey already dey live for Gazira and e get some wey run leave Khartoum wen di wahala start for safety reasons.
Di Nigerian tok say im prayer be say di kata kata no go reach wia dem dey.
“Our hope and prayer be say di wahala no go reach dis side and even for Khartoum, wey= dey pray for di war to end.”
E say e dey wish Nigerians wey run due to di war well and e hope to also start a new life for Nigeria wen im program go finish in months.
Second set of Nigerians from Sudan expected
Na Friday dem dey expect di second batch of Nigerians to arrive.
Di first batch of Nigerian students and odas wey bin dey stranded for Sudan sake of di crisis dia don come back.
Dem land di Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja around 11.30pm on Wednesday.
Dem land ontop di military jet C13 around 11:40 pm.
Na ova 350 Nigerians arrive on both di military jet and commercial airline AirPeace wey bin offer to go for di evacuation exercise.
'I dey sleep wen I hear di first gunshot'
Arun Musa wey dey study Educational Administration for di International University of Africa tell BBC Pidgin say na im first time for Nigeria since five years.
E say 15 April, 2023 na day wey im no go fit forget for im lifetime.
Im say im bin dey sleep wen im hear di first gunshot.
"Actually, I bin dey sleep on di 15th of April 2023, I just hear gunshot and bomb near my surroundings. I just get up from bed in shock, I begin see animals dey run from every corner, we humans too begin run, na only short nika I wear wit singlet. We begin run but we no know wia we dey go.
Our school try for us, na dem protect us .
Plenty tins dey to tok but I tank God say I don reunite wit my family and e sweet my belle." E tok.