You are here: HomeAfricaBBC2021 08 07Article 1327003

BBC Pidgin of Saturday, 7 August 2021

    

Source: BBC

Wizkid sell out O2 Arena in 12 minutes - See oda stars wey don do dat kain tin

Wizkid concert go happun for November 2021 Wizkid concert go happun for November 2021

Tickets for Wizkid only concert for London wey go happun for November 2021 don sell out.

Di afrobeat giant announce dis one for inside social media wia e reveal say, im sell am finish within just 12 minutes.

Dis show na part of odas im dey do for im "Made In Lagos" tour wey im currently dey run.

Meanwhile some fans don dey para on top say Wizkid bin only plan one show for di kontri.

Di last time Wizkid sell out di Arena na for 2018 wia im bin di headline act for Afrorepublik.

Wizkid dey with oda ogboge acts dem wey sell out di arena like dat.

Five acts wey sell out O2 in 12 minutes or less

  • Beyoncé: Queen B sell out within 12 minutes for 2014 as she visit London for her The Mrs. Carter Show World Tour.


  • Rihanna: Di Umbrella star bin sell out in O2 within 10 minutes for 2011 for her Loud tour. Tori be say na train she carri do di concert.


  • The Spice Girls: Di girl group make di record afta dem sellout dia reunion tour for 2007 in 38 seconds.


  • Monty Python: When Monty Python gada again afta 34 years for di O2, dem sellout ten shows in 43 seconds


  • The Rolling Stones: Omo na 7 minutes e take dis ogbonge rock band to sellout dia 50th anniversary show for 2012.

  • Apart from that, Davido too reveal say im sell out im concert for January 2019.

    Fans reaction to Wizkid sold out show

    Many pipo don dey para say dem no get di tickets.

    As one pesin hala say to get ticket be like Olympic sports.


    Anoda hala on top how e fit die say im no get ticket.

    And anoda pesin hala on top how dem dey wait for ticket.

    Why dis O2 Arena sell-out na big deal?

    Di Arena get di capacity to hold 20,000 pipo.

    Di Arena bin start out as di Millennium Dome wey dem build in honour of di third millennium wey begin for 2000.

    Na one of most popular entertainment venue for UK, on top say, dem get way to block out echo wey be wahala for many music venues.

    Dis na also as di venue only dey open for 200 days out of di year and na di third most sold out venue for di world.

    Read full article